Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 25

Tabernacle​​—Place Wey Dem for Dey Worship God

Tabernacle​​—Place Wey Dem for Dey Worship God

When Moses dey top of the mountain, Jehovah tell am sey make e build tabernacle where dem go dey worship am. Dem go fit carry the tabernacle as dem dey go.

Jehovah tell am sey: ‘Tell the people sey make dem bring anything wey dem fit bring to build the tabernacle.’ Israel people start to dey bring their earring, necklace, gold, silver and better stone wey dem dey wear like diamond. Dem still bring wool, linen, animal skin and many other things. Dem bring many many things sotey Moses tell dem sey: ‘E don do! Make una no bring again.’

Many men and women wey sabi the work, join hand to build the tabernacle. Jehovah give dem sense to do the work. Some of dem dey make thread, dey weave cloth and dey sew am. Some other people dey arrange stone, dey work with gold and dey carve wood.

Dem build the tabernacle as Jehovah tell dem. Dem sew fine curtain take divide the tabernacle, one side na the Holy the other side na the Most Holy. For inside the Most Holy, ark of the covenant wey dem make with acacia wood and gold dey inside. For the Holy, one table, one lampstand wey dem make with gold, and one altar wey dem dey use burn incense dey inside. One basin and one big altar dey outside the tabernacle. The ark of the covenant dey make Israel people remember sey dem promise to obey Jehovah. You know wetin covenant mean? Covenant na special promise.

Jehovah choose Aaron and im pikin to work for the tabernacle as priest. Dem go dey take care of am and dey make sacrifice to Jehovah. But na only Aaron wey be high priest get right to enter the Most Holy. E dey enter there once every year to sacrifice to Jehovah for im own sin, im family sin and all Israel people sin.

Israel people build the tabernacle finish one year after dem comot for Egypt. Now, dem don get where dem go dey worship Jehovah.

The cloud wey dey top of the tabernacle, show sey Jehovah like wetin dem do. When the cloud dey top of the tabernacle, Israel people go dey where dem dey. But when the cloud comot, dem know sey na time to comot be that. Dem go carry different different part for the tabernacle follow the cloud.

‘Na so I come hear one loud voice from where the throne dey, sey: “See! God house dey for where people dey, and e go stay with dem and dem go be im people. And na God imself go dey with dem.”’​—Revelation 21:3