Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 68

Elizabeth Don Born Pikin

Elizabeth Don Born Pikin

After 400 years when dem build Jerusalem fence finish, one priest stay near there. Im name na Zechariah and im wife name na Elizabeth. Dem don marry for many years, but dem no get pikin. One day wey Zechariah go burn incense for where dem dey call Holy for the temple, angel Gabriel appear to am. Zechariah come dey fear, but angel Gabriel tell am sey: ‘No fear, na good news from Jehovah I carry come. Your wife, Elizabeth go born boy pikin and e name go be John. Jehovah don choose John to do one special work.’ Zechariah come ask am sey: ‘Why I go believe you? Me and my wife don too old to born pikin.’ Angel Gabriel come tell am sey: ‘Na God send me to come tell you this good news. But because you no believe me, you no go fit talk until e born the pikin.’

Zechariah stay there pass as e suppose stay. When e come out, people wey dey wait am for outside come dey ask am wetin happen. But Zechariah no fit talk to dem, na im hand e come take dey sign. The people come know sey God don tell am something.

E no too tey, Elizabeth come get belle and e born boy pikin as the angel don talk. Elizabeth friends and family people come see the pikin. Dem happy for am well well. Elizabeth come tell dem sey: ‘Im name go be John.’ Dem come tell am sey: ‘Nobody for your family dey bear John. Call am Zechariah wey be im papa name.’ Zechariah come write sey: ‘Na John be im name.’ God come make am dey talk again. The news reach everywhere for Judah, people come dey talk sey: ‘Who this pikin go be when e grow?’

Holy spirit come full Zechariah body. E come talk sey: ‘Make we praise Jehovah. E promise Abraham sey e go send the Messiah wey go come save us. John go be prophet and e go clear road for the Messiah.’

Another better thing still happen to Mary wey be Elizabeth family person. We go see am for the next lesson.

‘Man no fit do this thing, but God fit do everything.’—Matthew 19:26