Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 59

Four Boys Wey Obey Jehovah

Four Boys Wey Obey Jehovah

When Nebuchadnezzar carry Judah elders go Babylon, e make one man wey dem dey call Ashpenaz oga for the palace. Nebuchadnezzar tell Ashpenaz sey make e find sharp boys and boys wey their body strong among the people wey dem carry from Judah. Dem go train the boys wey dem choose for three years. Dem go come be people wey their level high for Babylon. The boys need to learn how to read, write and speak Babylon language wey be Akkadian. Dem go still dey chop the kind food wey the king and people for the palace dey chop. Daniel, Hananiah, Mishael, and Azariah dey among the boys wey dem choose. Ashpenaz come give dem new Babylon name, e give dem Belteshazzar, Shadrach, Meshach, and Abednego. You think sey wetin dem want teach dem go make dem stop to dey serve Jehovah?

Their four ready to continue to dey obey Jehovah. Dem know sey e no good to chop the king food because, some food wey the king dey chop na wetin God Law sey make dem no chop. Dem tell Ashpenaz sey: ‘Abeg, no force us chop the king food.’ Ashpenaz tell dem sey: ‘If una no chop the king food and e see sey una lin, e go kill me!’

Daniel get better plan. So, e tell Ashpenaz sey: ‘Abeg give us only vegetable and water for ten days. And see whether the other boys go fresh pass us.’ Ashpenaz gree for am.

After the ten days, their body fresh pass the other boys own. Jehovah happy sey dem obey am. E even give Daniel sense and e make am dey understand dream and vision.

As Ashpenaz train all the boys wey dem choose finish, e carry all of dem go meet Nebuchadnezzar. As the king dey talk to dem, e see sey Daniel, Hananiah, Mishael, and Azariah sharp and get sense pass the other boys. E come choose their four make dem dey work for im palace. The king dey always tell dem to advice am for important matter. Jehovah don make dem get sense pass all the elders and juju priest.

Even though sey dem dey another country, Daniel, Hananiah, Mishael, and Azariah no forget sey dem be Jehovah people. What of you, you go always remember Jehovah even if your papa and mama no dey with you?

‘No let anybody treat you anyhow because you be young person. Instead, dey show people wey dey serve God well sey you be better example for how you dey talk, wetin you dey think, how you dey take show love, for faith, for clean life.’—1 Timothy 4:​12