Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 69

Angel Gabriel Visit Mary

Angel Gabriel Visit Mary

Elizabeth mama sister pikin name na Mary. Mary dey stay Nazareth wey dey Galilee. Joseph wey be carpenter don promise to marry Mary. When Elizabeth belle don reach 6 months, one angel appear to Mary. The angel tell am sey: ‘Mary, well done o! Jehovah don favor you well well.’ But Mary no know wetin the angel mean with that word. The angel come tell am sey: ‘You go get belle and you go born boy pikin, na Jesus go be im name. E go rule as King. And e Kingdom no go end.’

Mary come tell am sey: ‘But I never sabi man. How I go take get belle?’ The angel tell am sey: ‘Nothing hard God to do. Holy spirit go enter your body, and you go born boy pikin. Elizabeth wey be your mama sister pikin don get belle.’ Na im Mary sey: ‘I be Jehovah slave girl. Make e happen to me as you talk am.’

Mary come go one town wey dey on top hill go visit Elizabeth. As e reach there, e greet am. The pikin wey dey Elizabeth belle come start to dey jump. Holy spirit come enter Elizabeth body, na im e sey: ‘Mary, Jehovah don bless you. Na better thing as my Lord mama come my house.’ Mary come sey: ‘I thank Jehovah with all my mind.’ Mary stay with Elizabeth for three months before e go back to Nazareth.

As Joseph hear sey Mary don get belle, e sey e no go marry am again. But one angel come tell am for dream sey: ‘No fear to marry Mary. E never do any bad thing.’ Joseph come marry Mary and e carry am go house.

‘Jehovah dey do anything wey e want do for heaven and earth.’—Psalm 135:​6