Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 72

Wetin Happen When Jesus Dey Young?

Wetin Happen When Jesus Dey Young?

Joseph and Mary dey stay Nazareth. Dem stay there with Jesus and all their other pikin. Joseph dey use im carpenter work support im family. E still teach dem about God Law. Im and im family dey go where dem for dey worship everytime. Dem still dey go Passover for Jerusalem every year.

When Jesus dey 12 years, dem travel go Jerusalem as dem dey do every year. People wey come do Passover full everywhere. After the Passover, Joseph and Mary come start to dey go back to their house. Dem think sey Jesus dey follow dem for back or e dey with their family people. But when dem start to dey find am, dem no see am.

Dem come go back to Jerusalem. Dem find Jesus for three days. Last last, dem come go find am for temple. Dem come see am sitdown for the centre of people wey dey teach for the temple. Jesus dey listen to dem and e dey ask dem better better question. The thing touch people wey dey teach well well sotey dem come dey ask Jesus question. When Jesus answer dem, dem go dey surprise. E clear for their eye sey Jesus understand Jehovah Law well well.

Joseph and Mary mind no rest at all. Mary tell Jesus sey: ‘My pikin, we don dey find you for everywhere! Where you dey since?’ Jesus answer am sey: ‘You no know sey I must dey here wey be my Father house?’

Jesus come follow Joseph and Mary go back to Nazareth. Joseph teach Jesus carpenter work. Which kind person you think sey Jesus be when e dey young? As Jesus dey grow, e continue to dey get sense, God and other people come like am.

‘O my God, na to do wetin you want na im I want, and your law dey inside my heart.’—Psalm 40:​8