LESSON 73
John Preach Sey the Messiah Dey Come
John wey be Zechariah and Elizabeth pikin, come be prophet when e don grow. Jehovah use John teach people sey the Messiah dey come. But instead of John to dey teach people for town or where dem dey worship, e go preach for desert. People dey come from Jerusalem and everywhere for Judea to come learn from am. E teach dem sey if dem want make God happy, dem go stop to dey do bad things. After the people listen to John finish, many of dem come repent. E come baptize dem for river Jordan.
John live simple life. Dem make the cloth wey e dey wear with camel hair. Na grasshopper and honey wey dey bush e dey chop. Many people want know John. Even Pharisee and Sadducee people wey dey carry shoulder, come meet am. John tell dem sey: ‘Make una change the way una dey live una life and repent. Make una no think sey una be special people because una sey una be Abraham pikin. That one no mean sey una be God pikin.’
Many people come ask John sey: ‘Wetin we go do to make God happy?’ John answer dem sey: ‘If una get two coat, make una give one to person wey need am.’ You know why e talk like that? E want make people wey dey listen to am know sey, if dem want make God happy, dem must love other people.
John tell people wey dey collect tax sey: ‘Make una dey talk true and make una no play anybody wayo.’ E tell the soldiers sey: ‘Make una no dey take bribe or talk lie.’
People wey be priest and Levite still ask John sey: ‘Who you be? Everybody want know.’ John answer dem sey: ‘Na me dey talk from desert to help people come serve Jehovah, as Isaiah don talk.’
People like wetin John dey teach dem well well. Many people come dey think whether na John be the Messiah. But John tell dem sey: ‘Person wey pass me dey come. I no even reach person wey go loose im sandal. I dey baptize people with water, but e go baptize people with holy spirit.’
‘This man come tell people wetin e know about the light, so that different different people fit believe because of am.’—John 1:7