Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 70

Angel Make People Know Sey Mary Don Born Jesus

Angel Make People Know Sey Mary Don Born Jesus

Caesar Augustus wey dey rule Rome sey make all Jew people go their land go register. Joseph family come from Bethlehem. So Joseph and Mary travel go there. But this time, e don dey near when Mary go born.

When dem reach Bethlehem, the only place wey dem see to sleep na where animal dey stay. Na there Mary for born Jesus. Mary use soft cloth wrap Jesus body, and e sofri put am for where dem dey put animal food.

Near Bethlehem, some people wey dey take care of sheep dey outside dey look their sheep for night. Before dem know, dem see one angel for up. Dem come dey fear, but the angel sey: ‘Make una no fear. I get good news for una. Dem don born the Messiah today for Bethlehem.’ Na im many angel appear for up tell dem sey: ‘Honor and praise to God wey dey heaven, and peace for people wey dey earth.’ Na im the angels comot. Wetin you think sey the people wey dey take care of sheep go do?

Dem tell theirself sey: ‘Make we dey go Jerusalem now now.’ Dem come rush go. As dem reach there, dem see sey Joseph, Mary and Jesus dey where animal dey stay.

Everybody wey hear wetin the angel talk come surprise. Mary think about wetin the angel talk well well and e no forget am. The people wey dey take care of sheep come go continue to dey look their sheep. Dem thank Jehovah for everything wey dem see and hear.

‘I come from God and I dey here. I no come by myself, na im send me.’—John 8:42