Jump go content

Skip go table of contents

Wetin Dey Part 12

Wetin Dey Part 12

Jesus teach people about God Kingdom wey dey heaven. E still teach dem sey make dem dey pray make God name dey holy, make im Kingdom come, and make wetin e want happen for earth. If you be papa or mama, teach your pikin wetin this prayer mean for us. Jesus no let Satan make am leave Jehovah. E choose im apostles, and dem dey among the first people wey God anoint with holy spirit. Dem get special work to do for the Kingdom. Try make you see how Jesus take show sey e love true worship well well. Because e want help other people, e make sick people well. E give people wey dey hungry food chop and e bring people wey don die come back to life. Jesus use all this things wey e do take show wetin God Kingdom go do for people wey obey Jehovah.

FOR THIS SECTION

Jesus Come Be Messiah

Wetin John mean when e sey Jesus na God Lamb?

Devil Come Test Jesus

Na three times Devil test Jesus. Which three things Satan take test Jesus? How Jesus take answer am?

Jesus Drive People Wey Dey Do Business for Temple

Wetin make Jesus drive all the animal for the temple and scatter the table of people wey dey change money?

The Woman Wey Come Draw Water for Well

One Samaria woman wey dey draw water for Jacob well, surprise sey Jesus dey follow am talk. Why? Wetin Jesus tell am wey e never tell anybody before?

Jesus Preach About God Kingdom

Jesus tell some of im disciples sey e go make dem dey ‘catch men alive.’ Later, e come train 70 of im disciples to preach the good news.

Jesus Do Many Miracle

Anywhere Jesus go, people wey dey sick dey come meet am make e help dem, and e dey make dem well. E even bring one small girl wey don die come back to life.

Jesus Choose 12 Apostles

Wetin make Jesus choose dem? You still remember their name?

Jesus Teach People for Mountain

Jesus teach many people wey gather better lesson.

Jesus Teach Im Disciples How to Pray

Which kind things Jesus sey make im disciples continue to dey ask?

Jesus Give Many People Food Chop

Wetin this miracle teach us about Jesus and Jehovah?

Jesus Waka for Top of Water

How you think sey the apostles go feel when dem see this miracle?

Jesus Open One Man Eye for Sabbath Day

Why e be sey no be everybody like wetin e dey do?

Jesus Bring Lazarus Come Back to Life

When Jesus see as Mary dey cry, e come start to dey cry. But dem no cry tey, before dem start to dey happy.