Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 80

Jesus Choose 12 Apostles

Jesus Choose 12 Apostles

After Jesus don preach for about one year and half, e get one big question wey dey im mind. The question be sey, which people e go draw near body to follow am work? Which people e go train to dey lead for congregation? Jesus want make Jehovah direct am as e want choose this people. E come go mountain where only im go dey, and e pray the whole night. When morning reach, e call some of im disciples and e choose 12 apostle among dem. Which of the apostle name you remember? Their name na Peter, Andrew, James, John, Philip, Bartholomew, Thomas, Matthew, James wey be Alphaeus pikin, Thaddaeus, Simon, and Judas Iscariot.

Andrew, Peter, Philip, James

Twelve of dem go dey travel with Jesus. After Jesus train dem finish, e send dem go preach. Jehovah give dem power to drive demon comot for people body. E still give dem power to cure sick people.

John, Matthew, Bartholomew, Thomas

Jesus call im 12 apostle im friend, because e trust dem. People wey dem dey call Pharisee think sey the apostles no know anything, and sey dem no go school. But Jesus no look dem like that. E train dem to do their work well. Dem go dey with Jesus anytime e need dem​​— before e go die and when God go bring am back to life. Like Jesus, many of the apostles come from Galilee. Some of dem even marry.

James wey be Alphaeus pikin, Judas Iscariot, Thaddaeus, Simon

All the apostle no free from sin, so dem dey make mistake. Sometimes, some of dem dey talk before dem think and this one dey make dem do wetin no correct. Sometimes dem no dey dey patient. Dem even argue about who big pass among dem. But all of dem na good people wey love Jehovah. Na dem go dey lead for the congregation when Jesus don go heaven.

‘I dey call una my friend, because I don tell una everything wey I hear from my Father.’—John 15:15