Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 86

Jesus Bring Lazarus Come Back to Life

Jesus Bring Lazarus Come Back to Life

Jesus get three tight friend wey dey stay Bethany. Their name na Lazarus, Mary and Martha. Dem be brother and sisters. One day wey Jesus go another place for Jordan, Mary and Martha come send one strong message go give am. Dem sey: ‘Lazarus dey sick well well. Abeg come quick quick!’ But Jesus no quick go. E stay for another two days before e tell im disciples sey: ‘Make we go Bethany. Lazarus dey sleep, I dey go there go wake am.’ The apostles sey: ‘If Lazarus dey sleep, e mean sey e go well.’ Na im Jesus make am clear for dem sey: ‘Lazarus don die!’

When Jesus reach Bethany, dem don bury Lazarus and e don pass four days. Many people come greet Martha and Mary. When Martha hear sey Jesus don come, e go meet am quick quick. E tell am sey: ‘Lord, if to sey you dey here, my brother for no die.’ Jesus tell am sey: ‘Your brother go come back to life. Martha, you believe am?’ Martha tell am sey: ‘I know sey e go come back to life for the last day.’ Jesus tell am sey: ‘Na me be the resurrection and the life.’

Martha come go tell Mary sey: ‘Jesus don come.’ Mary come run go meet Jesus, and many people follow am. E come kneel down for Jesus front, and continue to dey cry. E tell Jesus sey: ‘Lord, if to sey you dey here, my brother for still dey alive.’ Jesus see sey the thing pain Mary reach bone, na im e start to dey cry. When people wey gather for there see sey e dey cry, dem sey: ‘Hmmm, Jesus really love Lazarus o!’ But some people come dey sey: ‘Wetin make am no come save im friend?’ Wetin you think sey Jesus go come do now?

Jesus come go where dem bury am, and dem use big stone cover the front. E tell dem sey: ‘Make una comot the stone.’ Martha come tell am sey: ‘But e don reach four days! Im body go don dey smell.’ Dem no reason that one, dem still comot the stone. Jesus come pray sey: ‘Father, I thank you sey you don hear me. I know sey you dey always hear me. But I dey talk because I want make this people know sey na you send me.’ Na im e use loud voice talk sey: ‘Lazarus, come out!’ Big miracle come happen. Lazarus come out from where dem bury am, and wetin dem take wrap am still dey im body. Jesus come sey: ‘Make una loose am make e go.’

Many people wey see wetin happen, come put faith for Jesus. But some people come go tell Pharisee people. From that day go, Pharisee people come dey find how dem go take kill Lazarus and Jesus. Judas Iscariot wey be one of Jesus 12 apostles come hide go ask dem sey: ‘How much una go pay me if I tell una where e dey?’ Dem tell am sey dem go pay am 30 silver money. Judas Iscariot come dey plan how dem go take catch Jesus.

‘The true God na God wey dey save us, and Jehovah wey be the Lord wey high pass go save us from death.’—Psalm 68:20