Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 74

Jesus Come Be Messiah

Jesus Come Be Messiah

John don dey preach sey: ‘Person wey pass me dey come.’ When Jesus dey about 30 years, e comot for Galilee go river Jordan. Na there John for dey baptize people. Jesus tell John make e baptize am, but John sey: ‘No be me suppose baptize you. Na you suppose baptize me.’ Jesus come tell am sey: ‘Jehovah want make you baptize me.’ Na im dem enter the river, John dip Jesus whole body for inside the water.

As Jesus come out from the water, e pray. Na once heaven open, God spirit come dey on top am like dove. Jehovah come talk from heaven sey: ‘You be my Son, wey I love; you dey make my mind sweet.’

Na when God spirit dey on top Jesus, e come be Christ or Messiah. Now, e don ready to start the work wey Jehovah send am come do for earth.

As Jesus baptize finish, e go stay desert for 40 days. When e come back, e come go see John. As Jesus dey waka near am, John sey: ‘Make una see God Lamb, wey go carry this world sin comot.’ Wetin John talk make people know sey na Jesus be the Messiah. You know wetin happen to Jesus when e dey that desert? Make we see.

‘One voice from heaven come talk sey: “You be my Son, wey I love; you dey make my mind sweet.”’—Mark 1:11