Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 79

Jesus Do Many Miracle

Jesus Do Many Miracle

Jesus come this earth to preach the good news about God Kingdom. To show wetin Jesus go do when e go be King, Jehovah give am holy spirit to do miracle. E fit cure any sickness. People wey dey sick dey come meet am anywhere e go, and e dey cure dem. E make people wey no dey see start to dey see, e make people wey no dey hear start to dey hear, e make people wey no fit waka start to dey waka, and e drive demon comot for people body. Sick person go well even if e touch only the down part of im cloth. People follow Jesus go anywhere e dey go. E no dey drive anybody comot for where e dey, even when e want rest.

One time self, people bring one man wey no fit waka come meet Jesus for one house wey e dey stay. Because people too many for the house, dem no fit enter. Dem come put hole for the roof of the house come carry the man pass there. Jesus tell the man sey: ‘Get up make you waka.’ As e start to waka, the people surprise.

Another time, Jesus come go one village. Ten men wey get one bad sickness wey dem dey call leprosy, stand for far place use loud voice tell Jesus sey: ‘Jesus, help us o!’ For their time, people wey get that kind sickness no dey near other people. Jesus tell dem sey make dem go temple. Na so Jehovah Law sey make people like that dey do when dem don well. As dem dey go for road, na im dem well. When one of dem see sey e don well, e go back go thank Jesus and praise God. Na only im thank Jesus among dem.

One woman wey don dey sick for 12 years dey find cure up and down. E waka go Jesus back for where many people dey, come touch the down part of Jesus cloth. Before you know, e don well. As that one happen, Jesus ask sey: ‘Who touch me?’ The woman come dey fear. But e gather mind come out, come tell Jesus sey na im. Jesus tell am wetin make im mind come down. E sey: ‘My pikin, make you dey go.’

One man wey dem dey call Jairus beg Jesus sey: ‘Abeg come my house! My small pikin dey sick.’ But before Jesus reach the house, the pikin don die. When Jesus reach there, e see am sey many people join the family dey cry. Jesus tell dem sey: ‘Make una no cry, the pikin dey sleep.’ Na im e hold the pikin hand tell am sey: ‘My pikin, get up!’ The pikin get up once come sitdown. Jesus tell im papa and mama sey make dem give am food chop. You no think sey im papa and mama go happy well well?

‘God anoint am with holy spirit and power, e come dey go everywhere for the land dey do good and dey heal people wey Satan dey oppress, because God dey with am.’—Acts 10:38