Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 85

Jesus Open One Man Eye for Sabbath Day

Jesus Open One Man Eye for Sabbath Day

Pharisee People hate Jesus well well sotey dem dey find how dem want take catch am. Dem sey make e no dey do miracle for Sabbath day, because that day na to rest. But one Sabbath day, Jesus see one blind man dey beg for road. E come tell im disciples sey: ‘Make una see how God power go help this man today.’ Jesus come mix im spit with sand sand, come put am for the man eye. E tell the man sey: ‘Go wash your eye for the pool wey dey Siloam.’ The man go the pool go wash im eye. Na that day come be the first time wey the man see for im life.

People surprise. Dem sey: ‘No be that man wey dey sitdown for road dey beg be this, or na another person wey resemble am?’ The man answer dem sey: ‘Na me be that man.’ The people come ask am sey: ‘Wetin come make you dey see?’ As the man tell dem wetin happen, dem carry am go meet Pharisee people.

The man tell the Pharisee people sey: ‘Jesus put something for my eye, and e tell me sey make I go wash am comot. I do wetin e talk, and now I dey see.’ Pharisee people come talk sey: ‘If Jesus dey do miracle for Sabbath day, na im be sey no be God give am the power.’ But other people sey: ‘If no be God give am the power, e no go fit do miracle at all.’

Pharisee people come call the man mama and papa, ask dem sey: ‘Wetin happen wey make your pikin dey see now?’ Im mama and papa dey fear because Pharisee people don sey dem go throwey anybody wey believe Jesus for outside. Dem come tell Pharisee people sey: ‘We no know. Make una go ask am.’ Pharisee people come dey ask the man question like sey tomorrow no dey, until e tell dem sey: ‘I never tell una everything? Why una still dey ask me?’ Pharisee people come dey vex, dem come throwey am for outside.

Jesus come go find the man. When e see am e ask am sey: ‘You get faith for the Messiah?’ The man answer am sey: ‘I go get faith for am if I know who e be.’ Jesus come tell am sey: ‘Na me be the Messiah’ You no think sey na better thing Jesus do? No be only sey e make the man see, e still help the man get faith.

‘Una no correct, because una no know God Word or how God get power reach.’—Matthew 22:​29