Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 76

Jesus Drive People Wey Dey Do Business for Temple

Jesus Drive People Wey Dey Do Business for Temple

About the year 30 C.E. for the month of April, Jesus go Jerusalem. This time, many people come there for Passover. People dey sacrifice animal for the temple as part of wetin dem dey do for the Passover. Some people carry animal come, but some dey buy for Jerusalem.

When Jesus enter the temple, e see some people dey sell animal for there. Dem dey do business for inside Jehovah house! Wetin Jesus do as e see dem? E use rope do cane, come use am drive sheep and cow comot for the temple. For people wey dey change money, e scatter their table and throwey their coins for ground. E tell people wey dey sell dove sey: ‘Make una carry this things comot for here! Make una no use my Father house dey do business!’

People wey dey the temple surprise for wetin Jesus do. Im disciple come remember wetin dem talk about the Messiah, wey sey: ‘I go get strong love for Jehovah house.’

For the year 33 C.E., Jesus clean the temple again. E no go let anybody use God house do yeye.

‘Una no fit serve God and Money together.’—Luke 16:13