Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 92

Jesus Appear to People Wey Dey Catch Fish

Jesus Appear to People Wey Dey Catch Fish

After some time when Jesus appear to im apostles, Peter come go the big river wey dey Galilee go catch fish as e dey do before. Thomas, James, John, and some other disciples follow am. Dem put their net for the river the whole night, but dem no see any fish catch.

When day break, dem see one man stand for dry land wey near the river. The man ask dem from where e stand sey: ‘Una catch any fish?’ Dem tell am sey: ‘We no see catch o!’ The man come tell dem sey: ‘Make una put una net for the right side of una boat.’ As dem put am, fish come full the net sotey dem no fit drag am enter their boat. Na that time John come know sey na Jesus, e come talk sey: ‘Na our Lord o!’ Na once Peter jump enter water, come dey swim go where Jesus dey. The other disciples use boat follow am.

When dem reach dry land, dem see sey bread and fish dey fire. Jesus come tell dem sey make dem put some of the fish wey dem catch, join the one wey dey fire. As e done, Jesus sey: ‘Make una come chop.’

As dem chop finish, Jesus ask Peter sey: ‘You love me pass to dey catch fish?’ Peter answer am sey: ‘Yes, my Lord, you know sey I love you.’ Jesus come sey: ‘Give my lamb food chop.’ Jesus ask am again sey: ‘Peter, you love me?’ Peter answer again sey: ‘My Lord, you know sey I love you.’ Jesus come tell am sey: ‘Take care of my small sheep.’ Jesus ask Peter that question again. Peter come weak. E tell Jesus sey: ‘My Lord, you know everything. You know sey I love you.’ Jesus come tell am sey: ‘Give my small sheep food chop.’ Jesus come still tell Peter sey: ‘Continue to dey follow me.’

‘Jesus come tell dem sey: “Make una follow me, and I go teach una how to catch people.” Quick quick, dem leave their net and start to dey follow am’ ​​—Matthew 4:​19, 20