Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 90

Jesus Die for Golgotha

Jesus Die for Golgotha

The chief priest carry Jesus go Governor Pilate palace. Pilate ask dem sey: ‘Wetin una sey this man do?’ Dem tell am sey: ‘E sey im na king.’ Pilate come ask Jesus sey: ‘Na you be Jew people King?’ Jesus answer am sey: ‘My Kingdom no dey part of this world.’

Na im Pilate come sey make dem carry Jesus go meet Herod wey be king for Galilee. E want make Herod see whether Jesus do any bad thing wey fit make dem kill am. But Herod no see any bad thing wey Jesus do wey fit make dem kill am, na im e sey make dem carry Jesus go back. Pilate come tell the people sey: ‘Me and Herod no see any bad thing wey this man do. I go free am.’ People wey gather for there come dey shout sey: ‘Kill am! Kill am!’ Soldiers come start to dey beat Jesus, dem flog am and spit for im body. Dem come use chukuchuku do cap wey King dey wear for am. Dem come put am for im head dey use am do yeye and tell am sey: ‘Welldone o! Jew people King.’ Pilate tell people wey gather again sey: ‘I no see any bad thing wey this man do o!’ But the people shout sey: ‘Make dem nail am for pole!’ Na im Pilate sey make dem go kill am.

Dem come carry Jesus go one place wey dem dey call Golgotha and nail am for pole. Dem come raise am up. Jesus come pray sey: ‘Father, abeg forgive dem because dem no know wetin dem dey do.’ Some people come dey use Jesus do yeye, dem tell am sey: ‘If na true sey you be God Son, come down from there. Make you save yourself.’

One of the thief wey dem nail near Jesus come tell am sey: ‘Abeg, remember me when you reach your Kingdom.’ Jesus promise am sey: ‘You go dey with me for Paradise.’ For afternoon, everywhere for the land come dark for three hours. Some of im disciples stand near the pole, even im mama Mary. Jesus come tell John sey make e take care of Mary like sey na im mama.

Last last, Jesus sey: ‘E don finish!’ As e bend e head, na im e die. Na once, ground come shake as e never happen before. For the temple, the heavy curtain wey dey middle of where dem dey call the Holy and the the Most Holy, come tear from up reach ground. One soldier man come sey: ‘E clear sey na God Son be this.’

‘No matter how God promise plenty reach, dem don be “Yes” because of am.’—2 Corinthians 1:​20