Jump go content

Skip go table of contents

Wetin Dey Part 14

Wetin Dey Part 14

Christian for the apostles time preach the good news about God Kingdom for different different place for the earth. Jesus show dem where dem go preach and e make dem fit speak different different language. Jehovah give dem power and e make dem get strong mind to face any wahala.

Jesus show apostle John how Jehovah throne fine reach. John see sey God Kingdom win Satan make e no dey control people again. E still see Jesus dey rule as King and 144,000 people dey rule with am. E still see sey the whole earth turn paradise where everybody dey worship Jehovah with one mind and peace dey.

FOR THIS SECTION

God Give Jesus Disciples Holy Spirit

Which miracle holy spirit make dem do?

Dem No Let Anything Stop Dem

Pharisee and other people wey kill Jesus want stop the disciples to dey preach. But their plan no work.

Jesus Choose Saul

Saul na person wey dey give Christian wahala well well because e hate dem, but that one go soon change.

God Give Cornelius Holy Spirit

Why God tell Peter sey make e go Cornelius house, even though sey e no be Jew?

The Good news Reach Different Different Place

Apostle Paul and people wey join am start the preaching for far far place.

Person Wey Dey Guard Prison Learn About God

Why dem put Paul and Silas for prison? How person wey dey guard prison take learn about God?

Paul and Timothy

Their two work together as friend and dem preach together for many years.

Dem Send Paul Go Rome

Apostle Paul face many wahala for road, but e no let anything make am weak.

The Things Wey John See

Jesus show am different different things wey go happen for front.

‘Make Your Kingdom Come’

The things wey Jesus show John show how God Kingdom go change our life for the earth.