Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 95

Dem No Let Anything Stop Dem

Dem No Let Anything Stop Dem

One man wey no dey fit waka dey sitdown for temple gate dey beg everyday. One afternoon, e see Peter and John dey enter the temple. Na im e tell dem sey: ‘Abeg make una give me something.’ Peter tell am sey: ‘I get something wey better pass money wey I want give you. I dey use Jesus name tell you sey, get up make you waka!’ Peter come hold the man hand stand, e come dey waka! People wey dey there happy well well for the miracle wey Peter do, sotey many of dem come be Christian.

But the priest and Sadducee no happy at all. Dem hold the apostles, come drag dem go court. Dem ask dem sey: ‘Who give una power to make this man waka?’ Peter answer sey: ‘Na Jesus wey una kill give us the power.’ People wey dey judge their matter come shout sey: ‘Make una stop to dey talk about Jesus!’ But the apostles sey: ‘We must talk about am. We no go stop.’

As dem free Peter and John, dem go meet the other disciples to tell dem wetin happen. All of dem come beg Jehovah for prayer sey: ‘Abeg help us get strong mind make we no stop to dey preach.’ Jehovah give dem holy spirit wey make dem continue to dey preach and do miracle. This one come make many people be Christian. Sadducee people come dey jealous the apostles, dem come arrest dem put for prison. But for night, Jehovah send angel go open the prison gate and tell the apostles sey: ‘Make una go back to the temple go teach.’

When day break, dem tell court people sey: ‘The prison still lock, but the people wey una arrest don comot. Dem dey teach people for temple now o!’ Dem come arrest the apostles again and carry dem go court. The high priest talk sey: ‘We never tell una before sey make una stop to dey talk about Jesus?’ Peter come answer sey: ‘Na God we go obey as ruler no be people.’

People wey dey judge their matter come dey vex sotey dem want kill the apostles. But one Pharisee person wey dem dey call Gamaliel stand up sey: ‘Make una take am easy! E fit be sey God dey with this people o! Una ready to fight God?’ Dem follow wetin Gamaliel talk. After dem flog the apostles finish, dem tell dem again sey make dem stop to dey preach. Dem come let dem go. But that one no make the apostles stop. Dem continue to dey use strong mind preach the good news for temple and for house to house.

‘Na God we go obey as ruler no be people.’—Acts 5:​29