LESSON 99
Person Wey Dey Guard Prison Learn About God
E get one girl wey be slave for Philippi. Demon dey use am tell people how their tomorrow go be. The girl dey use this power dey make money for all im oga. When Paul and Silas preach reach Philippi, the girl come dey disturb dem. E come dey shout follow dem sey: ‘This people na God servant o!’ When Paul tire for am, e use God power drive the demon comot from the girl body.
When all im oga see sey Paul and Silas don “pour sand sand for their garri,” dem come vex well well. Dem come carry Paul and Silas go court and lie for the judge sey: ‘Paul and Silas no dey obey law and dem dey cause wahala for the town.’ Because of that lie, the judge come sey make dem beat dem and put dem for prison. Na the place wey bad pass for prison dem put dem and dem still chain their hand and leg make dem no fit move.
That night wey dem dey prison, Paul and Silas come dey sing to praise Jehovah. Other people for the prison dey listen to dem. Before you know, the whole prison start to shake. All the door open, the chain wey dey their hand and leg cut comot. The person wey dey guide the prison come rush enter see sey the door open. So e want come use sword kill imself because e think sey everybody don run.
Na im Paul shout tell am sey: ‘No kill yourself o! We never run, we still dey here.’ The man come rush enter inside kneel down for their front and ask dem sey: ‘Wetin I go do to get life?’ Paul come tell am sey: ‘Make you and your family get faith for Jesus.’ Paul and Silas come teach dem about Jehovah and all of dem come baptize.
‘People go catch una and suffer una, dem go carry una go synagogue and dem go put una for prison. Dem go carry una go meet king and governor because of my name. This one go give una chance to preach.’—Luke 21:12, 13