Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 98

The Good news Reach Different Different Place

The Good news Reach Different Different Place

Jesus apostles do wetin e talk to preach for the whole earth. For the year 47 C.E., the brothers wey dey Antioch send Paul and Barnabas go preach. Dem like to dey preach and dem preach for Derbe, Lystra, Iconium and everywhere for Asia Minor.

Paul and Barnabas no select people, whether dem get money or dem no get. Dem still preach to young and old people. Many people gree sey wetin dem talk about Jesus na true. When dem dey preach to Sergius Paulus wey be governor for Cyprus, one juju man come dey disturb dem. Paul tell am sey: ‘Jehovah go punish you!’ Na once, e blind. When Sergius Paulus see wetin happen, e come dey serve God.

Paul and Barnabas preach for everywhere. Dem preach to people for their house, for market, for road and even for where dem dey worship. When dem reach Lystra, dem make one man wey no dey fit waka start to dey waka. People wey see am want come dey worship Paul and Barnabas because dem think sey dem be god. But dem no gree, dem tell the people sey: ‘We be human being like una o! Make una worship only God!’ Some bad people come spoil the better mind wey the people get for Paul. Dem beat am well well, stone am and even push am for ground dey think sey e go die. But Paul no die. E no tey, the brothers come carry am enter house and treat am. When im body strong, e come go ­Antioch.

For the year 49 C.E., Paul travel go preach again. After e don see the brothers for Asia Minor finish, e travel go other far far place like Athens, Ephesus, Philippi and Thessalonica. Silas, Luke and Timothy still follow Paul preach. Dem work together to start many congregation and help the brothers serve God well. Paul stay Corinth for one year and six months to make the brothers get strong mind to serve God. Apart from sey Paul preach and teach, e still write many letter to different congregation. Paul work na to dey do tent. After some time, e go back to Antioch.

For the year 52 C.E., Paul travel go preach for the third time. E start for Asia Minor, come go Philippi before e reach Corinth. Paul stay Ephesus for many years dey teach people. E still cure people and  help the congregation. Na everyday e dey give talk for school hall. Many people listen as e dey preach and dem come dey serve God. Last last, after Paul don preach for many many place, e go back to Jerusalem.

‘So make una go make people my disciple for the whole world.’—Matthew 28:19