Jump go content

Skip go table of contents

Wetin Dey Part 3

Wetin Dey Part 3

After the heavy rain for Noah time, people wey come dey serve Jehovah no many. One of dem na Abraham and we still know am as God friend. Wetin make God sey Abraham na im friend? If you be papa or mama, help your pikin see sey God love am and e want help am. Like Abraham and other people like Lot and Jacob wey serve God, we fit beg Jehovah sey make e help us. We dey sure sey Jehovah go do everything wey e don promise.

FOR THIS SECTION

Dem Build Tall House for Babel

People come sey dem want build one house wey tall reach heaven. Wetin make God make dem speak different different language?

Abraham and Sarah Obey God

Why Abraham and Sarah leave everything wey dem get, come go be stranger for Canaan?

Sarah Don Born Pikin!

How God go take do wetin e promise Abraham? Which of Abraham pikin e want use—Isaac or Ishmael?

Lot Wife No Obey Jehovah

God use fire and sulfur wey fall like rain take destroy Sodom and Gomorrah. Why God destroy the two city? Why e good make we remember Lot wife?

Jehovah Test Im Faith

God tell Abraham sey: ‘Abeg, go use your only pikin do sacrifice for me for the mountain wey dey Moriah.’ How Abraham go take face this test for im faith?

Na Jacob Come Get the Property

Isaac and Rebekah get twins, their name na Esau and Jacob. Because na Esau dem first born, na im suppose get the property as senior pikin. Wetin make am throwey am because of ordinary plate of stew?

Dem Settle Their Quarrel

Wetin Jacob do wey make am fit get blessing from one angel? And how e take settle with Esau?