Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 9

Sarah Don Born Pikin!

Sarah Don Born Pikin!

Abraham and Sarah don marry for many many years. Dem don leave the better place wey dem dey stay for Ur, come dey stay tent. But Sarah no complain, because e know sey na wetin Jehovah want better pass.

Sarah want pikin well well sotey e tell Abraham sey: ‘If Hagar born pikin for you, e fit be like my own.’ As time dey go, Hagar come born pikin. The pikin name na Ishmael.

Many many years after that time, when Abraham dey 99 years and Sarah dey 89 years, three people come visit dem. Abraham sey make dem come rest under one tree and make dem chop food together. You know who the three people be? Dem be angels. Dem tell Abraham sey: ‘By this time next year, una go get pikin.’ Sarah dey inside dey listen. E come laugh sey: ‘I fit really born pikin as I don old reach?’

True true, the next year, Sarah born pikin as the angels promise dem. The name wey Abraham give the pikin na Isaac. The name mean “Laughter.”

When Isaac dey about five years, Sarah come see sey Ishmael dey always use Isaac do yeye. Because e want protect Isaac, e tell Abraham sey make e drive Hagar and Ishmael. Abraham no first gree drive dem. But because Jehovah want still protect Isaac, e tell Abraham sey: ‘Listen to Sarah, I go take care of Ishmael. But na from Isaac family I go do wetin I talk.’

‘Because sey Sarah get faith, e fit get belle to born pikin, because e trust the Person wey talk the promise.’—Hebrews 11:​11