Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 12

Na Jacob Come Get the Property

Na Jacob Come Get the Property

Isaac dey 40 years when e marry Rebekah and e love am well well. As time dey go dem born twins. Their two na boy.

The senior one name na Esau, and the junior one name na Jacob. Esau like to dey go outside, and e sabi catch animal well well. But Jacob like to dey stay house.

For olden days, na senior pikin dey get money and property pass, if e papa die. For Isaac family, the senior pikin suppose still gain from the promise wey God promise Abraham. Esau no reason all that promise, but Jacob value am well well.

One day, after Esau don catch animal finish, e come tire. E smell the sweet food wey Jacob dey cook and e tell am sey: ‘I dey hungry! Abeg give me small red stew!’ Jacob tell am sey: ‘I go give you, but first promise me sey na me go get your property as senior pikin.’ Esau sey: ‘E no concern me! You fit take am, na food concern me now.’ You think sey wetin Esau do make sense? For where! Esau throwey better thing because of ordinary plate of stew.

When Isaac don old well well, e want come bless im senior pikin. Rebekah come help Jacob wey be the junior make e for take the blessing. When Esau know, e vex well well come even dey plan to kill Jacob. Isaac and Rebekah want protect Jacob, so dem tell am sey: ‘Go stay with Laban wey be your mama brother until Esau mind come down.’ Jacob listen to their advice and run for im life.

‘Wetin man go get if e gain the whole world and lose im life? Wetin man fit really give to get im life back?’—Mark 8:​36, 37