Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 13

Dem Settle Their Quarrel

Dem Settle Their Quarrel

Jehovah promise Jacob sey e go protect am as e protect Abraham and Isaac. Jacob come dey stay Haran, and na there e for marry. E come get many children with plenty money and property.

Jehovah come tell Jacob sey: ‘Go back to the land wey you come from.’ So Jacob and im family come start to dey travel go back. As dem dey go, Jacob servant come meet am and tell am sey: ‘Your brother Esau dey come, and 400 men dey with am!’ Jacob dey fear sey Esau want come kill im and im family. E come tell Jehovah for prayer sey: ‘Abeg no let my brother kill me.’ The next day, Jacob send many sheep, goat, cow, camel, and donkey go give Esau.

When only Jacob dey that night, e see one angel! Im and the angel come dey fight. Dem fight till day break. Even though sey Jacob wound, e no gree leave am. The angel come tell am sey: ‘Leave me make I go.’ But Jacob sey: ‘Lai lai, you go bless me first.’

The angel come later bless am. Na now Jacob come know sey Jehovah no go let Esau do am anything.

That morning, Jacob come look front see sey Esau and 400 men dey come. Jacob come waka go front of im family, come bow down for im brother seven times. Esau run go meet Jacob and hold am join body. Their two come dey cry and dem settle their quarrel. How you think sey Jehovah feel about the way Jacob take settle the quarrel?

Later, Esau come go im house, and Jacob continue to dey travel. Jacob get 12 boy pikin. Their name na Reuben, Simeon, Levi, Judah, Dan, Naphtali, Gad, Asher, Issachar, Zebulun, Joseph, and Benjamin. Jehovah later use Joseph take save im people. You know how e take happen? Make we see.

‘Make una continue to dey love una enemy and pray for people wey dey give una problem. Na that one go show sey una be una Father wey dey heaven pikin.’—Matthew 5:​44, 45