Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 14

One Slave Wey Obey God

One Slave Wey Obey God

Na Joseph be Jacob second to last boy. But im senior brothers see am sey na im their papa like pass. You think sey this one make dem happy? For where! Dem jealous am, come even hate am. When Joseph dream one kind dream, e tell im brothers. The dream mean sey dem go bow down for am. This one come make dem hate am well well.

One day wey Joseph brothers dey take care of sheep near Shechem, Jacob send Joseph go see how the work dey go. When im brothers see am dey come from far far, dem come dey tell theirself sey: ‘See this one wey dey dream anyhow. Make we kill am!’ Dem drag am, come throwey am inside one deep hole. But Judah wey be one of im brother sey: ‘Make we no kill am! Make we sell am as slave.’ Dem come sell am for 20 silver money to Midian people wey dey go do business for Egypt.

Joseph brothers come soak im coat for inside goat blood give their papa. Dem come ask am sey: ‘No be your pikin coat be this?’ This one come make Jacob dey think sey na animal kill Joseph. E pain Jacob well well no be small. Nobody fit make e mind come down.

Dem sell Joseph as slave to one big man wey im name na Potiphar wey dey stay Egypt. But Jehovah no leave Joseph. Potiphar see am sey Joseph dey do im work well and na person wey dem fit trust. Before you know, e put Joseph to dey control everything wey e get.

Potiphar wife see sey Joseph fine well well and e dey strong. Na everyday e dey beg Joseph make e sleep with am. Wetin Joseph go come do? E no gree sleep with am, e talk sey: ‘No! E no make sense. My oga trust me, and you be im wife. I no go sleep with you because God hate am!’

One day Potiphar wife try to force Joseph sleep with am. E hold Joseph cloth, but Joseph run comot. When Potiphar come house, e wife tell am sey Joseph want rape am. But na lie be that. Potiphar come dey vex well well sotey e throwey Joseph for prison. But Jehovah no still forget Joseph.

‘Carry yourself come down because you dey God strong hand, so that e go raise una go up when time reach.’—1 Peter 5:6