Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 22

The Miracle Wey Happen for Red Sea

The Miracle Wey Happen for Red Sea

As Pharaoh hear sey Israel people don comot for Egypt, e change im mind again. E command im soldier sey: ‘Make una ready all una horse wey una take dey fight make we pursue dem. We for no let dem comot.’ Na so Pharaoh and im soldier start to dey pursue Israel people.

Jehovah dey use cloud dey lead im people for day and fire for night. E lead dem reach Red Sea and tell dem sey make dem build small tent.

Israel people come dey see Pharaoh and im soldier dey pursue dem. E come be like sey dem dey trap because the Red Sea dey their front and Pharaoh and im soldier dey come from their back. Dem come dey cry to Moses sey: ‘Na die we dey so o! You for leave us for Egypt.’ But Moses tell dem sey: ‘Make una no fear. Make una wait and see how Jehovah go save us.’ You no think sey Moses really trust Jehovah?

Jehovah tell Israel people sey make dem go one side. That night, Jehovah move the cloud and put am for the middle of Egypt and Israel people. For Egypt people side, everywhere dark. But Israel people side no dark.

Jehovah tell Moses sey make e stretch im hand for the water. E come make strong breeze blow that night. The sea come divide, and where dem fit waka pass dey the middle. All Israel people waka for dry ground, for middle of the water wey don divide.

Pharaoh and im soldier start to dey follow dem pass the dry ground. But Jehovah confuse dem. Their wheel start to dey comot for their horse. Dem come dey shout sey: ‘Make we comot for here! Jehovah dey fight for dem.’

Jehovah tell Moses sey: ‘Stretch your hand for the water.’ Na once the water cover Egypt soldier. Pharaoh and all im soldier die. No one save at all!

As Israel people cross the Red Sea finish, all of dem come dey praise God with one song sey: ‘Sing to Jehovah, because e don show sey e level high well well. E don throwey the horse and people wey dey ride am for sea.’ As the people dey sing, the women dey dance and play tambourine. Everybody come dey happy sey dem don free.

‘So that we fit get strong mind to talk sey: “Na Jehovah dey help me; I no go fear. Wetin person fit do me?”’—Hebrews 13:6