LESSON 19
The First Three Things Wey God Take Punish Egypt
Egypt people force Israel people work as slave. Jehovah tell Moses and Aaron sey make dem tell Pharaoh sey: ‘Let my people go make dem go worship me for desert.’ Pharaoh say e no care about wetin Jehovah talk, e sey: ‘Israel people no dey go anywhere.’ Pharaoh come force dem to dey work pass before. Jehovah go show Pharaoh pepper! You know how e take do am? E punish Egypt people ten times. Jehovah tell Moses sey: ‘Pharaoh no dey listen to me. Tomorrow morning, e go dey river Nile. Go meet am and tell am sey as e get stronghead so, all the water for river Nile go turn to blood.’ Moses obey, so e go meet Pharaoh. Pharaoh dey look Aaron as e nack the Nile river with im stick, na im the water turn to blood. The river come dey smell, fish come dey die for inside, and people no come see better water drink for there again. But Pharaoh no still let dem go.
After seven days, Jehovah tell Moses make e go meet Pharaoh again and tell am sey: ‘If you no let my people go, frog go full Egypt.’ But Pharaoh no still let dem go. Na im Aaron raise im stick and frog start to full everywhere. Dem see frog for their house, their bed and their plate. Frog full everywhere! Pharaoh come sey make Moses beg Jehovah make e stop am. E promise sey e go let Israel people go. So Jehovah stop am, na im Egypt people start to dey gather all the frog wey don die. Everywhere come dey smell. But Pharaoh no still let dem go.
Jehovah come tell Moses sey: ‘Make Aaron nack ground with im stick and dust go turn to small small fly wey dey bite.’ Na once, fly wey dey bite full everywhere. Some of Pharaoh people come dey tell am sey: ‘Na God dey punish us so.’ But Pharaoh no still let dem go.
‘I go make dem know my power and my force, and dem go know sey my name na Jehovah.’—Jeremiah 16:21