Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 26

Twelve People Wey Hide Go Look Canaan

Twelve People Wey Hide Go Look Canaan

As Israel people comot from the mountain, dem pass the desert wey dey Paran go Kadesh. Jehovah tell Moses for there sey: ‘Send 12 men, one one from all the tribe make dem go hide look Canaan, the land wey I want give Israel people.’ Na im Moses choose 12 men come tell dem sey: ‘Make una go Canaan go look whether the land good to grow food. Make una see whether the people weak or dem strong and whether dem dey stay tent or dem get strong fence.’ Their 12 come start to dey go, Joshua and Caleb dey among dem.

After 40 days, their 12 come back with different different fruit. Dem sey: ‘Na good land, but the people strong and their city get high fence.’ Caleb come sey: ‘We go win dem. Make we no waste time at all!’ You know wetin make Caleb talk like that? Na because im and Joshua trust Jehovah. But the other ten people sey make dem no try am because the people “grab like giant.” Dem still sey dem be like ant for their front.

Israel people come weak. Dem come start to dey complain to theirself sey: ‘Make we choose another person wey go carry us go Egypt. Why we go go die for that place?’ Joshua and Caleb tell dem sey: ‘Make we obey Jehovah and make we no fear. Jehovah go protect us.’ But Israel people no gree hear word. Dem even want kill Joshua and Caleb.

Wetin Jehovah come do? E tell Moses sey: ‘After everything wey I don do for Israel people, dem still no want obey me. Dem go stay desert for 40 years and dem go die for there. Na only their children, Joshua and Caleb go stay the land wey I promise dem.’

‘Wetin make una dey fear, una wey get small faith?’—Matthew 8:​26