Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 23

Israel People Promise Jehovah

Israel People Promise Jehovah

Two month after Israel people comot from Egypt, dem reach the mountain wey dey Sinai and dem build small tent wey dem go stay. Jehovah call Moses go mountain come tell am sey: ‘Na me save Israel people. If dem obey my law, dem go be my special people.’ As e come down from the mountain, e tell Israel people all the things wey Jehovah talk. Wetin dem come talk? Dem sey: ‘We go do everything wey Jehovah tell us.’

Moses come go the mountain again. Jehovah tell am for there sey: ‘After three days, I go talk to you. Warn the people sey make dem no try am near the mountain.’ Moses come down come tell Israel people sey make dem ready to hear wetin God want talk.

When that three days reach, Israel people see lightning and up of the mountain dark finish. Dem still hear loud thunder and horn sound. Na im Jehovah come the mountain like fire. Israel people fear sotey dem come dey shake. The whole mountain come dey shake well well and smoke cover am. But the horn sound dey loud more more. Na that time God come sey: ‘I be Jehovah, make una no try am worship any other god.’

As Moses go the mountain again, Jehovah give am law about how the people go take dey worship am and how dem go dey do things. Moses write the law down and e read am for dem. Dem promise sey: ‘We go do everything wey Jehovah tell us.’ Na true sey dem promise God, but dem go do wetin dem promise?

‘Make you love Jehovah your God with all your heart, all your mind, and all your body.’—Matthew 22:⁠37