Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 32

One New Leader and Two Women Wey Get Mind

One New Leader and Two Women Wey Get Mind

After Joshua don lead Israel people for many many years, e die when e dey 110 years. When e dey alive, Israel people serve Jehovah. But when e die, dem start to dey serve juju like Canaan people. As e be sey Israel people stop to dey serve Jehovah, Jehovah allow one king for Canaan wey be Jabin suffer dem well well. Israel people come dey beg make Jehovah sorry for dem. This one come make Jehovah give dem one new leader. Im name na Barak. Barak go help dem start to dey serve Jehovah again.

Deborah wey be woman prophet send people go call Barak. Jehovah tell am make e tell Barak sey: ‘Take 10,000 men, make una go meet Jabin soldier for the river wey dey Kishon. Na there you go for win Sisera wey be the oga of Jabin soldier.’ Barak tell Deborah sey: ‘If you no follow me, I no dey go.’ Deborah come tell am sey: ‘I go follow you. But know sey no be you go kill Sisera. Jehovah don sey na woman go kill am.’

Deborah follow Barak go the mountain wey dey Tabor go ready for the war. As Sisera hear sey dem dey there, e gather im soldier and im horse wey e dey use fight go there. Deborah tell Barak sey: ‘Jehovah go let you win today.’ Na im Barak and im 10,000 men start to dey go meet Sisera and im soldier.

Jehovah come make the river wey dey Kishon over full, na im everywhere come full with water. Sisera horse wey e take dey fight come sink for potopoto. Sisera leave im horse and start to dey run. Barak and im soldier win dem, but Sisera run comot. E run go hide for one woman tent. The woman name na Jael. Jael give am milk drink and cover am with thick cloth. Sisera wey don tire well well start to sleep. Jael come sofri waka go meet am, e come use pin wey dem take dey make tent nail im head. Sisera come die.

Barak come dey find am. Na im Jael come out from im tent tell am sey: ‘Come inside. I go show you the man wey you dey find.’ As e enter, e see sey Sisera don die. Barak and Deborah use song praise Jehovah because e make Israel people win their enemy. For the next 40 years, Israel people get peace.

‘The women wey dey preach the good news many well well.’—Psalm 68:11