Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 36

Jephthah Promise Jehovah

Jephthah Promise Jehovah

Israel people still leave Jehovah go serve juju. But when Ammon people come fight dem, their juju no fit help dem. This one come make dem suffer for many years. Last last, dem come tell Jehovah sey: ‘We don sin. Abeg save us from our enemy.’ Israel people come scatter all their juju and start to dey serve Jehovah again. Jehovah no want make dem continue to dey suffer.

Jehovah come choose one man wey sabi fight well well make e lead dem go fight Ammon people. Im name na Jephthah. E promise Jehovah sey: ‘If you help me win this fight, I promise you sey if I come back, I go give you the first person wey come out from my house come greet me.’ Jehovah hear im prayer and help am win the fight.

When Jephthah come back, the first person wey come out come greet am na im only pikin. The pikin na girl. E dey play tambourine dey dance come greet im am. Wetin Jephthah go come do? E remember im promise and sey: ‘Eeeh, my pikin! You don finish me. I promise Jehovah something. For me to do am, I must send you go work for tabernacle wey dey Shiloh.’ Im pikin come talk sey: ‘Papa, if you don promise Jehovah, you must do am. The only thing wey I want be sey, make you let me go stay with my girlfriends for mountain for two months. If I come back, I go go.’ Jephthah pikin serve Jehovah well for tabernacle till e die. Every year, im friends dey come see am for there.

‘Person wey like im papa and mama pass me, no reach to follow me.’—Matthew 10:37