Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 38

Jehovah Give Samson Power

Jehovah Give Samson Power

Many Israel people start to dey serve juju again, this one come make Jehovah let Philistine people control their land. But some people still dey wey love Jehovah. One of dem na Manoah. Im and im wife no born pikin. One day, Jehovah come send one angel go meet im wife. The angel tell am sey: ‘You go born pikin. Na im go save Israel people from Philistine people hand. E go be Nazirite.’ You know who Nazirite be? Nazirite na special person wey dey serve Jehovah. Anybody wey be Nazirite no dey barb im hair.

After some time, Manoah born pikin, e call am Samson. Jehovah give am power well well as e dey grow. E even kill lion with im own hand. One time like that, only im kill 30 Philistine people. So, Philistine people hate am well well. One night when e dey sleep for Gaza, Philistine people go wait am for gate make dem for kill am for morning. But e get up for midnight go the city gate and pull am comot from the fence. E carry the gate for im shoulder go top of the mountain for Hebron!

Later, dem come go meet Samson girlfriend Delilah and tell am sey: ‘We go pay you 5,500 silver money if you fit tell us wetin make am get power like that. We want catch am put for prison.’ Delilah gree for dem because e want the money. Samson no first gree tell am wetin make am get power. But Delilah continue to dey worry am until e tell am sey: ‘Dem never barb my hair because I be Nazirite. If dem barb my hair, I no go get power again.’ You no think sey Samson make big mistake to tell am?

Delilah rush go tell Philistine people sey: ‘I know wetin make am get power!’ E come make Samson sleep for im lap and e call person come barb im hair. Delilah come shout sey: ‘Samson, Philistine people don come o!’ As Samson wake up, e see sey e no get power again. Philistine people come catch am, blind im eye and put am for prison.

One day, many many Philistine people gather for the temple wey dem for dey worship their god Dagon and dem dey shout sey: ‘Our god don make us catch Samson. Carry am come out! Make we use am do yeye.’ Dem come put am for middle of two pillar and start to dey use am do yeye. Samson come pray sey: ‘O Jehovah, abeg give me power this last time.’ This time, Samson hair don grow again. E push the pillar for the temple with all im power. The whole temple come fall reach ground, and everybody die. Samson self still die.

‘For everything I dey get power from the person wey dey give me power.’—Philippians 4:13