Jump go content

Skip go table of contents

Wetin Dey Part 7

Wetin Dey Part 7

This part talk about wetin happen to King Saul and King David, and e take about 80 years. Saul first be person wey no dey carry shoulder and person wey dey serve God well. But as time dey go, e leave Jehovah. Jehovah come comot am from king and e tell Samuel make e choose David as the next king. Saul try to kill David many times because e dey jealous am, but David no try to do am back. Jonathan wey be Saul pikin know sey na David Jehovah choose, so e support am. David do some bad things, but e no vex when Jehovah correct am. If you be papa or mama, help your pikin see sey e good to dey do wetin Jehovah talk.

FOR THIS SECTION

The First king Wey Rule Israel

Jehovah give Israel people judge wey dey lead dem, but dem sey dem want king. Samuel make Saul Israel first king, but Jehovah later comot the kingdom from e hand. Why?

David Kill Goliath

Jehovah choose David as Israel next king, and David show wetin make am be the right person.

David and Saul

Wetin make one of this men hate the other one, and how the one wey dem hate behave?

Jonathan–Better Friend Wey Get Mind

The king pikin come be David tight friend.

King David Do Bad Thing

One bad thing wey person do bring big wahala.