Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 49

God Punish One Wicked Queen

God Punish One Wicked Queen

If King Ahab look from the window wey dey im palace, e dey see the farm of one man wey dem dey call Naboth. Ahab want the farm, so e try buy am from Naboth hand. But Naboth no gree sell the land give am because God Law show sey e no good to sell land wey dem share reach you. Naboth do the correct thing. But you think sey Ahab happy with am? For where! E pain Ahab well well. E vex am sotey e no gree comot for im room and e no gree chop.

Ahab wife wey be wicked Queen Jezebel tell am sey: ‘Na you be Israel king. You fit get anything wey you want. I go help you collect the land.’ Jezebel come write letter go give the elders wey dey the city sey make dem lie for Naboth head sey e dey curse God and make dem stone am till e die. The elders do wetin Jezebel tell dem. After dem don kill am, Jezebel tell Ahab sey: ‘Naboth don die. Na you get the farm now.’

But no be only Naboth be the better person wey Jezebel kill o! E still kill many people wey love Jehovah. E dey serve juju and e do many bad things. But Jehovah dey see everything wey e dey do. Wetin Jehovah go come do am?

After Ahab die, e pikin Jehoram come be king. Jehovah come send one man wey dem dey call Jehu make e go punish Jezebel and im family.

Jehu come ride im horse go where Jezebel dey stay for Jezreel. Jehoram ride horse come meet Jehu ask am sey: ‘We get peace so?’ Jehu answer am sey: ‘We no go fit get peace because Jezebel your mama dey do bad things.’ As Jehoram want run, Jehu use arrow shoot am. Jehoram come die.

Jehu come go meet Jezebel for im palace. As Jezebel hear sey e dey come, e start to dey make up and do im hair. E come go wait for im window wey dey upstair. As Jehu reach there, Jezebel start to dey talk anyhow. Na im Jehu shout give Jezebel servant wey near am sey: ‘Make una throwey am come down!’ True true, dem throwey Jezebel pass window and e fall for ground die.

After that one, Jehu come kill Ahab 70 boy pikin, e still comot all the juju from the land. You no think sey Jehovah dey see everything, and e know the correct time wey e go punish bad people?

‘Any property wey you first use wayo get no go be blessing for the end.’—Proverbs 20:21