Jump go content

Skip go table of contents

LESSON 46

Jehovah Show Sey Na Im Be the True God

Jehovah Show Sey Na Im Be the True God

Many bad king rule the ten-tribe kingdom for Israel, but na king Ahab bad pass. E marry bad wife wey dey worship Baal. Im name na Jezebel. Ahab and Jezebel make people worship Baal and dem kill many of Jehovah prophet. Wetin Jehovah go come do? E send prophet Elijah go meet Ahab.

Elijah tell King Ahab sey because of the bad things wey e dey do, Jehovah no go let rain fall for Israel. True true, rain no fall and plant no grow for Israel for three years. People come dey hungry. Jehovah come still send am go meet Ahab again. Ahab come tell am sey: ‘You dey find trouble! Na you cause am.’ Elijah answer am sey: ‘No be me make the rain no fall. Na you cause am because you dey worship Baal. Make we test to see who be the true God. Gather the people and Baal prophet on top of the mountain wey dey Carmel.’

The people come really gather for the mountain. Elijah tell dem sey: ‘Make una make up una mind. If na Jehovah be the true God, make una follow am. But if na Baal, make una follow am. I dey challenge una sey make the 450 Baal prophet prepare sacrifice and pray to their god. I go prepare sacrifice and pray to Jehovah. Any one wey answer with fire na im be the true God.’ Everybody gree for wetin e talk.

Baal prophet prepare their sacrifice. Dem start to dey pray to their god the whole day sey: ‘O Baal, answer us!’ As Baal no answer dem, Elijah start to dey use dem do yeye. E tell dem sey: ‘Make una shout well well call am. E fit be sey e don sleep, and somebody need to wake am.’ From morning till evening, Baal prophet pray make e help dem. But e no answer dem.

Elijah put im sacrifice for altar and e pour water on top am. E come pray sey: ‘O Jehovah, make people know sey na you be the true God.’ Na once Jehovah send fire come from heaven come burn the sacrifice. The people come dey shout sey: ‘Na Jehovah be the true God!’ Elijah come tell dem sey make dem no let Baal prophet run. Dem kill the 450 Baal prophet that day.

When small cloud show for up, Elijah tell Ahab sey: ‘Heavy rain dey come o! Ride your chariot fast fast go house.’ Up come dark, breeze come dey blow, heavy rain come start to dey fall. Last last, rain don fall! Ahab ride im chariot fast fast as e fit. But because Jehovah help Elijah, e run pass the chariot. But this one mean sey Elijah problem don end? Make we see.

‘Make people know sey you, wey your name na Jehovah, na only you High Pass for the whole world.’—Psalm 83:18