Wetin Dey Part 9
This part talk about young people, prophet and king wey show sey dem get strong faith for Jehovah. For Syria, one young girl wey come from Israel believe sey Jehovah prophet go make Naaman well. Prophet Elisha use all im mind believe sey Jehovah go save am from people wey be im enemy. Jehoiada wey be high priest put im life for danger to save Jehoash from im wicked grand mama Athaliah. King Hezekiah believe sey Jehovah go save Jerusalem, and e no let Assyria people make am leave Jehovah. King Josiah comot juju worship from Israel, build the temple again and help people to serve Jehovah again.
FOR THIS SECTION
The Soldier and the Small Girl
One small girl wey come from Israel dey tell im madam about Jehovah strong power—wey dey make people well.
Jehovah Horse and Chariot Wey Fire Dey
How Elisha servant come take see sey people wey dey with dem many pass people wey dey with Syria.
Jehoiada—Priest Wey Get Mind
One priest wey serve Jehovah well no gree for one wicked queen.
Jehovah Dey Patient With Jonah
Wetin make big fish swallow one of God prophet? How e take comot? And wetin Jehovah make am know?
Jehovah Use Im Angel Save Hezekiah
Sennacherib sey Jehovah no go save Judah, but e no correct!
Josiah Love God Law
Na eight years Josiah be when dem make am king for Judah, and he help im people make dem worship Jehovah.